Art of Tea - Tea of the Month

Afcon draw 2023 result: Nigeria, Ghana, Senegal, Egypt, Cameroon and odas know dia fate

Wia dis foto come from, Getty Images

12 October 2023

Di draw for di CAF Africa Cup of Nations, Afcon, happun on Thursday wia all di participating kontris don know which team dem go face.

Di draw ceremony hold for di brand-new Parc Des Expositions, for Abidjan wia popular music star, Akon be part host.

According to di format wey Caf release for di tournament, di 24 participating teams dey divided in six groups.

Di opening match go feature di hosts, wey be di Elephants of Cote d’Ivoire to face Nigeria.

Na di host kontri dey top of Group A while Egypt dey head Group B, Senegal dey head Group C, Algeria dey head Group D, Tunisia dey head Group E and Morocco dey head Group F according to di Fifa ranking.

Afcon 2023 groups

Wen be Afcon 2023?

Na five cities go host di competition for Ivory coast and six official stadiums dem go use for di tournament – Alassane Ouattara Olympic Stadium – Ebimpe, Felix Houphouet Boigny Stadium – Abidjan, Stade De La Paix – Bouake, Stade Amadou Gon Coulibaly – Korhogo, Charles Konan Banny Stadium – Yamoussoukro and Laurent Pokou Stadium – San Pedro

Dis na di 34th edition of di tournament wey go bring nations togeda.

Na Cote d’Ivoire dey host di 2023 edition of Afcon – di biggest football event for Africa.

Di competition dey hold for January 2024 but di tournament na actually Afcon 2023.

Excitement don dey build up across di continent as 24 kontris go battle diasef to win di tournament.

Dis edition of di Afcon dey scheduled to hold from 13 January to 11 February 2023 wia 24 contending nations go participate as di city of Abidjan go host di opening and closing ceremony.

Na di second time Ivory Coast don host di finals, afta dem first do am for 1984.

Di tournament suppose take place originally for June-July 2023, but dem move am sake of di fear say na during heavy rainy season.

Upon say dem move am go 2024, di official title go still remain Afcon 2023.

Why dem postpone Afcon 2023 to 2024

Dis 34th edition of di 2023 Africa Cup of Nations for Ivory Coast go happun for first two months for 2024 according to how di president of Confederation of African Football Patrice Motsepe bin announce di new date for july.

Di tournament suppose hold for June-July 2023 but dem postpone am sake of di heavy rain wey go fall around dat time for Ivory Coast.

For 2017, Caf announce say dem go move di finals from dia traditional January-February slot to June-July as dem try to avoid repeated disputes wit European clubs wey go dey forced to release players for di middle of di season.

Motsepe later add say .”January no be di ideal time becos of di European clubs, but dis na di only choice we get .”

(0 votes) 0/5
Share on facebook
Facebook
Share on twitter
Twitter
Share on linkedin
LinkedIn
Share on whatsapp
WhatsApp
Share on email
Email
[oa_social_login]
[oa_social_login]